We Plenti-Cobhams Asuquo

We Plenti

专辑:We Plenti

时间:2020-01-06

    使用手机浏览器「扫一扫」

    在手机上保存,获得更好体验

标签
猜你喜欢的歌曲
歌词

We Plenti - Cobhams Asuquo/Simi

Lyrics by:Cobhams Asuquo

Composed by:Cobhams Asuquo

You don hustle tire you no dey take holiday

You write application you go for auditions but still

E be like say e no dey pay

Them don laugh you tire

Some say shey until your mate get

Aeroplane before you go make am

You beg God to make am but see

Everybody get lane

So my brother hustle so my sister work

No condition last forever your own turn dey come

So my brother hustle so my sister work o

Beans no dey cook forever your own beans go done

If you see person wey make am o rejoice with them

If them ask you what's your

Own iyo take no offence

See this life na turn by turn

O your time dey come because

No be only you kill Jesus we plenty for there

Oh

One day e go better one day

One day someday make we bet am

When they tell you money no be everything

You dey vex you dey para

You say me sef I wan get am o

So my brother hustle

Kara woshe oh

No condition last forever

Your own turn dey come

Oh make you hustle hustle hustle make you work iyo

Beans no dey cook forever

Your own beans go done oh your beans go done

If you see person wey make am o rejoice with them

If them ask you what's your own iyo take no offence

See this life na turn by turn

O your time dey come because

No be only you kill Jesus we plenty for there

So the person wey work hard

O from night till dawn

Na the person wey go chop if e no give up

See this life na turn by turn

O your time dey come because

No be only you kill Jesus we plenty for there

So my brother hustle

So my sister work

No condition last forever

Your own turn dey come

So my brother hustle oh my sister work iyo

No condition last forever

Your own turn dey come

If you see person wey make am o rejoice with them

And if them ask you what's your

See this life na turn by turn

O your time dey come because

No be only you kill Jesus by yourself

So the person wey work hard o from night till dawn

Na the person wey go chop if e no give up

See this life na turn by turn

O your time dey come because

We plenty for there

We plenty for the matter

We plenty for there

No let your hope scatter

We plenty for there

Ah ahhh

No be only you kill Jesus

We plenty for there

展开显示全部歌词