MONEY MY CRUSH
(noise in the background)
(Phone ringing)
Hey silence, money dey call me
Money my crush any good news for me ?
You don show, oh e don sure for me
Your face show and you know your shoes shine
With u in my life, you know I am fine
I no fit love another, na u I dey find
I want to make u my bride, so I fit call u my wife
A yes from u can make everything fine,
OH MY GOD, u accept
No forget bring the papers me I want sign
Na me and u till the day I d!e
(Ommo na wedding straight with money oo)
(Phone calling mum)
HELLO MUMSY your prayer don work
Shai u know madam comfort, money my crush?
I no loose na me she dey come for
U sef u no loose I go buy you Lexus
HELLO MY PADDI, call all the artists
make all of them dey practice
Cos for this wedding I want everything perfect
No forget the dancers,
make them dance like say them dey the finals
It's my pleasure to break up with SAPA
No more link up, I no want yawa
We no fit link up I get a new lover
Bye bye to SAPA cos me I don jakpa
Tell all the bouncers say no room for SAPA
Incase him show, abeg make them bounce am