
在手机上保存,获得更好体验
This cool dry breeze wey just dey blow
Reminds me of one thing
My skin go white my lips go dry
The usual harmattan feel
All my Neighbours don dey feed their fowl
Make e fat by 25th
Oh Ai!
This Christmas go sweet
Market don dey full of course
The price of things go rise
Oh you Better rush buy Christmas clothes
And store your bag of rice
All these rushing feelings and merry spirit
Colors the yuletide
Oh Ai!
This Christmas go sweet
I get my Christmas fowl dey my yard
My house dey bling bling from the Christmas light
And every street corner, dem dey blow knockout, morning till night
Oh Ai!
This Christmas dey Sweet
I don pack my bag for night
Tomorrow i hit the road
No matter where hustle carry you go
Christmas brings you home
Cos the rice dey sweet and chicken stew
When you chop with your family
Oh Ai!
This Christmas Dey sweet
I get my Christmas fowl dey my yard
My house dey bling bling from the Christmas light
And every street corner, dem dey blow knockout, morning till night
Oh Guy, this Christmas dey Sweet.
Oh Oh Oh Oh
No matter how the economy wan be
Oh oh ai
This Christmas go sweetie
I get my Christmas fowl dey my yard
My house dey bling bling from the Christmas light
And from year to year we go know one thing
Na the love wey Christmas dey bring